Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di Federal Government don hold serious meeting with foreign diplomats for Abuja on Wednesday to clear di air about di US wahala wey say Nigeria dey persecute people because of religion. Di Permanent Secretary for Ministry of Foreign Affairs, Dunoma Ahmed, talk say all di talk about religious wahala no true at all, say Nigeria law no dey favor any religion pass another. E talk say both Christians and Muslims dey worship freely and say even Shari’a law wey dey some northern states na only for Muslims and e still dey under di main judicial system. Di Minister of Information, Mohammed Idris, join mouth say di US don misjudge Nigeria situation, talk say di killings and terrorism no be religion matter but na pure crime. E yarn say since Tinubu enter office, over 13,500 terrorists don die, 17,000 suspects don dey custody, and 9,850 kidnapped people don get freedom. E add say Tinubu dey use diplomatic channel take settle di matter and correct di false image wey America get about Nigeria.
Meanwhile, Minister of Aviation, Festus Keyamo, don write US President Donald Trump tell am say Nigeria no dey kill Christians as dem claim. Keyamo talk say even Tinubu wife, Oluremi, na pastor and im children na Christians, so di talk about Christian genocide na fake gist. For im own corner, former INEC Commissioner Prof. Lai Olurode warn say make FG no use emotion reply Trump, make dem use sense and diplomacy before wahala go too much. Senator Ita Enang too advise FG make dem no rush react anyhow, say na matter wey fit cause big foreign policy gbege. As e be, di Air Force Chief, Air Marshal Sunday Aneke, don order all commanders make dem fly smarter and strike harder against terrorists across di country, say di fight go continue until peace return fully to Nigeria.
Written by: News Editor 1
FG response to Trump Nigeria military meeting Trump threats Nigeria
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025