Entertainment

Drugs Wahala: Regina And Nwoko Don Enter Fresh Bitter Showdown

todayNovember 10, 2025 59

Background
share close

Di marital wahala between Delta North Senator, Ned Nwoko, and Nollywood actress, Regina Daniels, don enter fresh dramatic stage as Regina admit say she don use drugs before, claim say Nwoko na him introduce am to drugs for him sexual pleasure. But Nwoko yan say na Regina brother, Sammy, wey first introduce am drugs and block all effort to help am recover. Nwoko allege say Regina family, especially Sammy and Lawrence, dey involve for di drug matter and no wan let her get better. E add say he don spend over N125 million to support Regina mother, pay for Sammy school and other needs, but dem dey sabotage rehabilitation. Nwoko also accuse Sammy of harrassing him children and staff, and claim say some video wey dey online na staged Nollywood scene.

Regina respond via Instagram say Nwoko dey exaggerate di story to ruin her image, admit say she don use drugs but insist na no be wetin cause their marriage wahala. She allege Nwoko dey encourage her drug use to satisfy him sexual interest, and accuse am of sexual assault, confinement, and forcing doctors to give her sedatives. She add say no legal marriage dey between dem and being with Nwoko don cost her prime years and career opportunities. Meanwhile, Sammy don dey arrested in Lagos, later transfer to Abuja and remanded pending bail. Amid di drama, Regina celebrate say her estranged parents don reconcile, but she still express fear and pressure over her brother’s safety, wey don spark concern among fans and social media users, as many dey call for calm and de-escalation of di bitter showdown.

Written by: News Editor 2

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 10


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds