Entertainment

Regina No Be 17 When Ned Marry Her, E Dey 19 – Mercy Johnson Okojie

todayNovember 10, 2025 46

Background
share close

Ossai Ovie Success, wey dey serve as aide to Delta State governor, don call out actress Mercy Johnson Okojie over claim wey say Regina Daniels dey 17 years when she marry lawmaker Ned Nwoko. Mercy post for her Instagram page say Regina na only 17, small pikin, when she tie knot with Ned.

Reacting to di post, Ovie post for Facebook say contrary to di claim, Regina dey 19 years when Ned marry her. Im write say, “Mercy Johnson should stop spreading lies, Regina was not 17 when Ned got married to her. Ned married Regina Daniels 2019!!! Regina Daniels date of birth is 10/10/2000 making her 19 years at di time. I am disappointed with dis age narrative thing. Honestly I don’t like what is going on. No marriage is perfect, we all get our wahala for our different marriages. Make we stop to dey push narrative wey fit destroy di love wey still dey between Regina and Ned.”

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 10


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds