Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di Federal Ministry of Education (FME) don send letter go give Vice Chancellors (VCs) of federal universities through di National Universities Commission (NUC), make dem submit full details of promotion arrears, unpaid salaries, third-party deductions, and pension arrears. Di order dey inside memo wey Deputy Director for Universities, J.N. Akpa, sign. Dis move come after Minister of Education, Dr. Tunji Alausa, announce say ₦2.3 billion don already release to pay lecturers wey still dey owe promotion arrears. Di memo talk say di info go help furnish Nigerian University Pension Management Company to fit process payment. All universities don get order make dem arrange di data for Excel table format and submit both hard and soft copy to NUC headquarters.
For statement wey ministry spokesperson Folasade Boriowo drop, Alausa confirm say di ₦2.3bn na Batch 8 of di salary and promotion arrears, wey pass through di Office of di Accountant-General of di Federation. E add say di payment na part of President Bola Tinubu plan to settle all long-standing welfare wahala for di university system. Di minister still talk say government dey round up plans to release third-party deductions and pension remittances soon, and from 2026, di Earned Academic Allowance (EAA) go enter lecturers’ regular salaries. E also mention say fresh funds don land under di Needs Assessment of Nigerian Universities to keep di sector strong. Dis latest move dey target some of di major issues wey cause ASUU to go on strike before dem suspend am after NLC and National Assembly intervene. But ASUU still dey demand make government pay three-and-half months withheld salaries, release revitalisation funds, implement di 2009 FG–ASUU agreement, and clear promotion arrears plus cooperative deductions.
Written by: News Editor 2
FG directs VCs Lecturers promotion arrears
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025