Entertainment

Burna Boy Chase Couple Comot For Dey Sleep For Im Concert

todayNovember 13, 2025 72

Background
share close

Grammy winner and Nigerian music star, Burna Boy, don cause another wahala again after e order one couple comot from im concert for Denver, United States, on Wednesday night because dem sleep while e still dey perform. Di drama start when Burna Boy pause im performance and vex say di guy girlfriend dey sleep for front row. “When I stand up here and see you with your girl sleeping in front of me, e dey vex me die, abeg, take her go house! I no go sing another song till una comot,” Burna Boy shout. Di crowd come join shout make di couple leave before Burna Boy continue im show after dem waka commot.

Di matter don cause plenty talk for social media as fans dey drag Burna Boy say im dey always embarrass people wey pay money come see am perform. Some people remind others say e don do similar thing before, one time e kick one fan wey rush stage hug am, another time e send person out for no dey dance. Many Nigerians don talk say Burna Boy don build reputation for chasing fans comot from im concert anyhow.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 10


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds