Entertainment

VeryDarkMan And Mr Jollof Throw Hands For Plane

todayNovember 17, 2025 31

Background
share close

Social media influencers VeryDarkMan (Martins Otse) and Mr. Jollof don jam one kind fight for United Nigeria Airlines flight wey dey go from Asaba to Lagos. Eyewitness dem talk say di wahala turn small gbege, as crew members and passengers try hold body stop di matter. Di fight na because di online palava wey dey between di two influencers still dey continue.

Details about di matter never too clear as United Nigeria Airlines never release official statement yet. One person wey dey di plane talk, “I don chop Jollof fada for inside plane. Man when dey bite. E nor shame, e dey bite. Man when dey bite. I beat dem, dey beg, dem dey help am.” Di koko na say di fight show say di beef wey dey online don waka enter real life.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 10


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds