Singer Davido first babymama, Sophia Momodu, don reveal say she never receive any child support from im. Sophia yarn dis one while she dey clear di air over wetin she call false story about dia pikin, Imade Adeleke, wellbeing.
For her Instagram story on Wednesday, Sophia talk say she don dey handle all responsibility for Imade for di past five years. She yan, “I never receive any child support from Davido, but our child no dey lack anything. She dey grow for safe and loving environment, and she dey very happy.” She also beg netizens make dem stop drag Imade into fake online story, afta people criticize her say she no allow di pikin attend Davido 33rd birthday for Atlanta.