Entertainment

2Baba Eye Comot Water As Marriage Gbege Grip Am For Neck

todayDecember 3, 2025 34 5

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Na wah oh! Nigerian music star, Innocent Idibia wey everybody sabi as 2Baba, don finally  open mouth talk wetin dey im mind for first time since di hot gbege with im wife, Natasha Osawaru burst everywhere for internet.

For im IG tori on Wednesday, 2Baba tok say e need help, omo di message short but e carry weight wey hit body like trailer.

E no finish there ooo, as im broda, Hyacinth Idibia, come yarn worry too, post am for Instagram join 2Baba hit song lyrics, talk say di koko don turn real gbege, beg make dem help am quick.

Di wahala first burst for UK, 2Baba and im wife enter one hot, fire-for-fire argument wey mad reach point wey police sef jam come, and dem even carry di singer hold small before mata calm.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 9


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds