obodo oyinbo

Somalis No Suppose Dey US – Trump

todayDecember 3, 2025 18

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

US President, Donald Trump don scatter ground for White House cabinet meeting for Tuesday as e burst out say e no want Somali immigrants for America at all, even rub insult on top Somalia head, yarn say di country “barely dey” and people for there just run up and down  dey kpai dia sef.

Na dis same time US immigration officials dey cook one heavy raid wey go hammer some somali pipo wey no get correct papers for Minnesota, di gist don make everywhere choke.

Ogas at di top for Minnesota don vex scatter, warn say dat movement fit scatter and wound innocent Somali-American citizens, as Trump gornment dey push more gbege wahala like green card wahala, asylum freeze, and Kristi Noem travel-ban plan for countries wey she claim dey say dey flood America with crime.

Trump still drag Congresswoman Ilhan Omar enter di fire, call am “incompetent,” but Omar no send am at all, reply am back sharp-sharp for social media, say oga Trump tok creepy and say di man need help fast fast, as di immigration tension dey boil like hot water for kettle nationwide.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app