By: Esther Ayoola
Nollywood actress Yvonne Jegede don clear clear marras for ground on how she land role for 2Baba classic hit, African Queen, and the story full with wahala and surprise.
The movie star explain oh, that she bin dey shoot movie, Missing Angel, when her phone ring, and that call actually change her life as she nor take expect.
Chairmo Charles Nova self bin dey near her, when the call come and him sef suk mout tell her say Uzor, the director of African Queen,”wan hala her, and next thing, dem ask her make she do the music video the very next day.
Yvonne talk say e shock her, she no expect am at all, as she waka enter music video world straight from movie set without any plan.