By: Esther Ayoola
Based on the rascality of the ogbonge diseases wey dem dey call, tuberculosis, Lagos State gorment like this like this don enter meeting appoint womens with capacity, including female lawmakers, newly elected female local government chairmen, and wives of lawmakers say make dem act as Ambassadors to fight tuberculosis for community level.
This particular event dem hold for First Lady Banquet Hall, Lagos House, wia the First Lady, Dr. Ibijoke Sanwo-Olu l charge di womens like touchlight charger, say make dem raise awareness, encourage early testing, reduce stigma, and support treatment for DI disease, tuberculosis
Madam Sanwo Olu even go ahead to caput that, three female lawmakers, seven female local government chairmen, 20 council chairmen wives, and seven lawmaker wives don officially join di fight against TB.