By: Alice Iduh
The russia, ukrain kwanta just dey gather weight everyday, say ukrainian president volodymyr Zelensky don enter area go meet pope leo xiv for him country house for castel gandolfo near rome on tuesday. Whether prayer im go collect or go gather army, nobodi know
However sha, according to aproko pipo, after meeting the pope, Zelensky go piante enter italian prime minister Giorgia Meloni office, wia dem go tuk about the war for kyiv.
Italy don dey supply weapons to ukrainesince but limit dem to use di weapon for dia country, and meloni don yan say she no go send troops, or join any monitoring wahala wey britain and france dey propose.