Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Rilwan Agbomeji
Still on di politcal movement, Osun State Govo, Ademola Adeleke don finally comout with im full chest, say im don join Accord Party to pursue im re-election wey go shelle for August next year.
Governor Adeleke first confirmate dis mata for im verified x page few days afta e resign from Peoples Democratic Party.
For im unveiling as new member, Adeleke tuk say e don actually register with Accord Party since November 6, 2025, and choose am as im new political platform wia im and im pipo go join bodi for di 2026 election.
Written by: News Editor 1
Accord Party Nigeria Adeleke news today Ademola Adeleke Accord Party Osun government update Osun governor news Osun politics
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025