By: Rilwan Agbomeji
Rivers State Govo, Siminalayi Fubara, don catapot imself from di pipos democratic party to di All Progressives Congress on Tuesday.
Di govo by imself, for imself and im pipo announce di move for Government House, Port Harcourt, just few days afta 17 PDP lawmakers also cross carpet to  di APC.
Fubara say im even meet President Bola Ahmed Tinubu to inform am about wetin dey shelle for di state.