By: Esther Ayoola
Unto securioty doings, like dis, lagos police comand don kramp two suspected traffic robbers for same place wia one woman blow alarm say gang dey wori pipo for ojota-ketu road, just one day ago.
Di women, bin package message send directly to di Lagos Police Public Relations Officer, via X, SP Abimbola Adebisi, She yarn say four boys rush her car for ojota bridge for broad daylight, korokoro when she dey waka with her pikin.
Di gbege no be small say dem even hammer her side window with stones and beta blow b4 dem enter her car.
Reacting to di report, SP Adebisi confamate dat officers from di Command Intelligence and Tactical Unit immediately ginger boys start operation response to di distress message.
Di Police yarn say dem never finish, dem dey hunt di remaining guys make road normal again for commuters.