By: Esther Ayoola
Naija, UK senior boxer Anthony Joshua say im don package beta blow for youtuber, Jake Paul for ring today for Miami, say Paul chor chor tukings, na today im go tidy am for ring.
Joshua tuk say e wan beat Paul make other online tuk tuk dem learn, dat, nor by to tuk and dat boxing dey im blood, even afta im loss to Daniel Dubois last year.
Jake Paul for Wednesday, sti tuk full ground give aproko pipo, say di fight go be biggest upset for sports history, and dat when dem dey tuk boxing, naim be box, say who be Joshua, so like dis ground don open for miami USA for dis ogbonge fight.