Anthony Joshua

25 Results / Page 1 of 3

Background

Sports

Peter Fury Warn Say Joshua Fit Knock Out Tyson Fury

Peter Fury, wey be Tyson Fury uncle and former trainer, don warn say Anthony Joshua fit knock out Tyson when dem finally meet for ring. Peter talk dis for interview, say na only two things fit happen, either Tyson go outbox Joshua and beat am, or Joshua go find im target and hand Tyson di first knockout loss of im career. E say di outcome go depend on di game […]

todaySeptember 22, 2026 13

Sports

Cardiff Principality Stadium Jump Enter Save Fury vs Joshua Fight

By: Mariam Ajayi Cardiff Principality Stadium jump enter center ring to save di heavy clash between Tyson Fury and Anthony Joshua after Wembley Stadium curfew almost scatter di match. Eddie Hearn and AJ don swear say di fight must happen for UK soil, but main broadcaster Netflix wan make di boxers fight by 2 AM midnight, so dat American fans fit watch di match live for dia own time zone […]

todaySeptember 15, 2026 20

Sports

Fury Dey Vex Say Joshua Wan Dodge Fight

By: Mariam Ajayi Tyson Fury don accuse Anthony Joshua say e dey try dodge dia fight, as di former heavyweight champion say e don tire to wait for confirmation. Fury say di fight wey dem expect to happen for November fit no happen again, as e tell Joshua make e talk whether e still wan fight am for 2026 or e don comot. Fury, wey don lose twice to Oleksandr […]

todaySeptember 7, 2026 16

Sports

Fury Confirm Say E Go Fight Joshua for New York

Former heavyweight champion Tyson Fury don confirm say e go face Nigerian-British boxer Anthony Joshua for Madison Square Garden, New York. Fury make di announcement for Instagram, but e no mention di exact date for di fight. Joshua and im promoter, Matchroom Boxing, never confirm di venue as of now. Di fight dey expected to happun for November, with November 20 reportedly being  di target date.

todaySeptember 3, 2026 18

Sports

Hearn Konfamate Say Joshua And Fury Go Fight

Boxing promoter Eddie Hearn don talk say announcement for di long-awaited Anthony Joshua versus Tyson Fury fight fit happen soon as negotiations enter “crunch week.” Both fighters don sign contracts to fight each other but Joshua deal reportedly say di fight suppose happen for United Kingdom. Organisers including Netflix and Saudi financier Turki Alalshikh dey push for di fight to hold for America, especially Madison Square Garden for New York, […]

todayAugust 25, 2026 19 3

Sports

Fury Say Fight With AJ Fit Scatter Over Money Matter

By: Kofoworola Olayinka Fight between Tyson Fury and Anthony Joshua never officially confirm yet, as money matter don dey cause problem for di proposed fight. Fury, 38, say negotiation don stall because Eddie Hearn and im team dey demand more money. Fury talk dis one for video while e dey exercise, saying di financial disagreement fit stop di fight from happening.

todayAugust 21, 2026 20

Sports

Joshua-Fury Fight Jam Rock say no place dey to fight di fight

By: Kofoworola Olayinka   Anthony Joshua and heavyweight fight don dey face wahala as promoter Frank Warren warn say dem don match break for di  November bout, say both team never agree wia dem wan fight. dem bin dey think say na Wembley Stadium dem go fight di fight before, like dis wi dey hear say na e Madison Square Garden for New York don become di new ring to […]

todayAugust 14, 2026 16

Sports

Joshua Promoter Tok Say Fury Fight Go Happen

By: Yusuf Abuh Promoter of Anthony Joshua, Eddie Hearn, don dismiss wetin Tyson Fury tok say dia long-awaited fight fit no hapun again. Fury go face Poland boxer Mariusz Wach for Thailand on Friday, while Joshua go enter ring against Albania boxer Kristian Prenga for Saudi Arabia on Saturday, and both fights na preparation before dia expected big showdown. Di two British heavyweight boxers never fight each other before, even […]

todayJuly 24, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds