By: Esther Ayoola
Nor be small tin, say Russian send bomb to Sloviansk for eastern Ukraine kill at least one person dead and five others wunjor.
According to Donetsk region military oga, di attack happen for area wey ukraine government still dey control for di war-torn region.
Dis one dey come for wia, US president Donald Trump and Ukraine leader Volodymyr Zelenskyy tuk say peace deal don dey make sense small after dem meet for Florida, forgetting say land matter still dey ground. And na di land mata dey bring dis latest qiance doings from Russia.
For Kharkiv region, governor Oleg Synegubov say three people ni wunjor from Russian attacks within the last 24 hours, including one 73-year-old woman for Hroza village.