Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Rilwan Agbomeji
Liverpool Football Club don share surprise update, dat Aaron Briggs, wey join di club as individual development coach for July 2024, go leave im role with immediate effect.
Di club post for dia official website on Tuesday dat, Briggs dey important part of Arne Slot backroom staff and e help Liverpool win last season Premier League.
Dem nor really give full gist on why im dey comot, but dat im work for player development and support behind di scenes make both staff and players appreciate am.
Liverpool give Briggs thank you message for im contribution and dey wish am better luck for im future.
Written by: News Editor 1
aaron briggs liverpool liverpool club statement liverpool coaching staff liverpool sack coach
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025