By: Esther Ayoola
Troops of Operation Hadin Kai don record big win for Borno State as dem arrest one suspected suicide bomber.
The man, Abubakar Mustapha, say bindey Banki town for Bama LGA wia security agents catch am with materials wey fit make Improvised Explosive Devices (IEDs).
Lt. Col. Sani Uba talk say preliminary investigation show say Mustapha dey plan attack and dem dey interrogate am to find him sponsors and collaborators.
For another operation, troops for Cameroon–Nigeria border stop one Peugeot wey carry six bags of urea fertilizer, wey fit still dey used for IED production.
Dem later arrest the dealer and recover another six bags, making total seizure reach twelve bags.