By: Rilwan Agbomeji
Peter Obi, wey be Labour Party presidential candidate for 2023, don officially dump LP join African Democratic Congress, ADC.
Obi yarn dis tori for Enugu on Wednesday, December 31, 2025, as coalition parties dey line up ahead of 2027 election.
Di former Anambra State governor tuk say na Naija mata push am take change party.
According to am, im move na how e wan take transform and rescue Nigeria from di present wahala.