National

Ondo Govo ginger mehn police to Guide Area

todayJanuary 2, 2026 8

Background
share close

By  Ebi Oboko

Ondo State Governor, Lucky Aiyedatiwa, dey vex serious, say jaguda boys dey worry pipo, so like dis im don send security make dem double for all communities and forest areas, after New Year attack for Ipele police station for Owo LGA.

The attack happen Wednesday night as plenty people dey attend night service to welcome 2026.

Di Govo say, di mata nor dey let am sleep, so im don put call to police and army brigade commander make dem send dia men to protect ondo people.

Im also meet heads of security agencies for Akure to review wetin happen and how to make sure, dat kin anyhow doings nor repeat e self for Ondo state.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app