By Ebi Oboko
Unto badness wey sup on new year day, say na Two people na kpai and at least six others wunjor for different road accident wey happen for Lagos on New Year’s Day.
According to Lagos state Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) oga, Adebayo Taofiq, say, one crash happen for Iyana Itire, Oshodi side, when Volkswagen commercial bus jam Toyota Sienna, wey make two people die.
For inside statement wey dem post for x on new year day, say LASTMA officers rush go the scene, clear road, and make sure the bodies, dem remove dem from road, while controling traffic.
Another accident happen for Ibeju Bridge, Lekki–Ajah Expressway side, when DAF tanker jam Opel Zafira, two people wunjor and dem carry dem go hospital for treatment.