National

President Tinubu Order Security To Kramp Niger State Jaguda Boys

todayJanuary 5, 2026 8 37

Background
share close

By Ebi Oboko

Oga Presido, Bola Tinubu dey vex seriously don order im olopka, army, vigilante say make dem carry dia rake and fork enter the bushes of Niger state environs to gbab di jaguda boys wey attack communities for Niger State, kill over 40 pipo and kidnap plenty others.

For statement wey im sign by imself on Sunday, Tinubu say im don send sms to wi Defence Minister, Service Chiefs, IGP and DSS boss to do james born track di pipo behind di Kasuwan Daji attack and bring dem to book.

To tell you how im vex reach, baba also order say, make dem rescue all di abducted victims sharp, sharp and tighten security for communities wey dey close to forest areas.

Di attack happen on Saturday for Agwara and Borgu local government areas of Niger State, and Tinubu call on Nigerians make dem joinbodi to fight, say, if not this jaguda boys go carry us do yeye.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app