Lagos

Lagos Pastor Nor Show Face For Police Station Over Rape Case

todayJanuary 6, 2026 12

Background
share close

By: Esther Ayoola

Police say Senior Pastor of Mountain of Liberation and Miracles Ministries, Chris Okafor, no honour invitation wey dem give am to report on Monday by 10am for State CID, Panti, Lagos, over alleged rape and other offences.

Police Public Relations Officer, Abimbola Adebisi, tuk on Sunday say di invitation na order from Commissioner of Police, Olohundare Jimoh, afta several complaints reach police.

According to police, dem invite di pastor make e come explain himself before Deputy Commissioner of Police in charge of SCID, as part of investigation into di allegations.

Police say dem dey handle di mata because the alleged offences fit cause breach of public peace, and investigation still dey go on.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app