By: Esther Ayoola
China Foreign Ministry don yarn again say dem no dey happy with wetin US dey do for Venezuela and dem ready join other countries make international law stand gidigba.
Dem tuk say dem ready to join hand with countries for di region to protect peace for Latin America plus Caribbean.
You sabi say, China don call on US make dem free Maduro sharp-sharp and stop dey topple government for Venezuela.
China yarn say di mata no be only Venezuela, e dey touch law, peace, and respect for authority across di region.