By: Rilwan Agbomeji
National Chairmo of Africa Democratic congress, David Mark, don go swear Senior Lawyer, Etigwe Uwa (SAN) say make im do Chairmo for di party Constitution Review Committee for Abuja.
Untop marras wey sup for di party headquarters for Abuja on Thursday, Mark tell di committee make dem work framework wey go promote inclusiveness, transparency and accountability, and still follow di party original principles.
Im say di party constitution na di moral guide and legal backbone, wey dey control ideology, behaviour and internal democracy.