OBODO NAIJA

APC Tok Tok Pesin Accuse Ministers of Corruption

todayOctober 23, 2026 6

Background
share close

Alwan Hassan, tok tok pesin for di All Progressives Congress (APC) Presidential Campaign Council, don point finger give some ministers for gornment say dem dey pay billions of naira to get appointment, as e tok say dem dey try recover di money after dem enter office.

Hassan yarn dis one for siddon tok with tori pipo on Thursday, October 22, 2026, as dem dey yarn how gornment dey release money to run ministries.

E say some ministers dey see gornment appointment as investment wey dem must get back dia money.

E press mouth say di matter no start with APC gornment alone, as e tok say e don dey happen before di party enter power.

However, Hassan no mention any minister by name, and e no bring out evidence to support di allegation.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds