National

Jaguda Boys Free Edo Doctor Afta N50m Ransom Reach Dia Hand.

todayJanuary 15, 2026 3

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Dr Ibrahim Tahir, don free after im family pay N50 million ransom to di jaguda boys wey carry am for Edo State.

Di wahala start for January 2, 2026, when Tahir and im younger brother dey open gate for dia  compound for City Pride Road, Igbira Camp, Auchi, na so jaduga boys carry dem go.

Unfortunately, di jaguda boys kill di younger brother, come drop im bodi for Orley River near di same area on January 5, but Dr Tahir finally release on Wednesday around 8pm afta family members first N20 million, come later pay N30 million.

Di family, friends, NGOs, and well-wishers join hand collect money, and dis case don draw attention to kidnapping wahala and how communities dey support victims for Edo State.

 

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app