By: Esther Ayoola
Residents of Makoko, Ilaje Aiyetoro Community, Yaba, say nor be small matching dem do for Lagos State House of Assembly yesterday, block part of di road dey protest say gorment go demolish dia buildings.
Di protesters, wey be affected residents, dey beg Lagos Gornment make dem limit di demolition to 100 metres, and dat if dey continue di way dem go, say plenty families go dey homeless.
According to di protesters, di demolitions dey destroy livelihoods and put families welfare for risk, and  dat make gornment tak am easy.