By: Esther Ayoola
Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don open onboarding and retreat programme for councilors for Lagos, tell dem make dem do dia touch lighting work with boldness.
Govo Sanwo Olu gather di councillors from all 377 wards of Lagos for Lekki to train dem, share policy ideas, and guide dem on legislative work.
Lagos state govo, wey im special advicer on environment, Olakule, Rotimi Akodu, represent, remind di councillors say, dia office na chance to serve people for grassroots and say good lawmaking, dey important for good governance.