By: Esther Ayoola
Syrian government share update, say dem don reach agreement with Kurdish-led Syrian Democratic Forces, SDF, say make dem stop to kill dia self.
Dis agreement dey come days afta plenty fight, fight between di Syrian gornment and di SDF for northeastern Syria.
According to report, SDF go comot from area wey dey west side of River Euphrates.
Syrian Presido Ahmed al-Sharaa tuk on Sunday say, gornment go put state work for al-Hasakah, Deir Az Zor, and Raqqa wey SDF dey bin control before.