By: Esther Ayoola
Report card don show from di Naija Drug Law enforcement Agency, say NDLEA don arrest 77,792 pipo wey dey involve for drug business and dem seize about 14,847 kilogram of illegal drugs for di past five years.
Na Retired Brigadier General Buba Marwa tuk dis one to tori pipo, during dia award ceremony for NDLEA headquarters for Abuja on Tuesday.
He tuk say all dis arrests and seizures don shake both local and international drug cartels, and show di workings of Naija against hard drugs.