By: Esther Ayoola
Japan court don sentence di killer of former Prime Minister Shinzo Abe, wey dem dey call Tetsuya Yamagami, to life in prison.
Yamagami bin admit say e shoot Abe for 2022, di mata sef ehn shock di whole Japan.
Prosecutor dem tuk say dis crime na “unprecedented” and e get serious effect for society.
Yamagami lawyer bin beg make court give am just 20-year maximum punishment, as di man dey 45 years but, Court just give dem deaf ear.