By: Esther Ayoola
Ukraine Presido, Zelenskyy don konfamate say officials from Ukraine, Russia and America go meet for di first time dis Friday and Saturday.
According to report, dis meeting go happen for Abu Dhabi, and e go hellep push ways to end di war for Ukraine.
Dis one sef dey come afta Zelenskyy tuk with US Presido Trump for Davos, im say security mata sef dem don settle and economic recovery plan sef dey ground.
On di other hand, Russia never tuk anything yet about dis meeting.