By: Esther Ayoola
Lagos State Commissioner of Police, Olohundare Jimoh, don order permanent deployment of police to Grange School and Greensprings School for Ikeja, afta threat of attack.
Dis move dey follow WhatsApp messages wey unknown Jaguda boys send, threaten security of di schools.
U sabi says konfam been report say make aproko pipo stop to dey spread fake news.
In response to di threat even though di police don check, management of di two schools order temporary closure on Wednesday and Thursday.
For letter to parents, Head of Grange School, Richard McMahon, say school nor dey for dis week because of security concern, even though immediate danger nor dey.