By: Esther Ayoola
Say United Nation, UN, Office for di Coordination of Humanitarian Affairs (OCHA) Don konfamat dat, UN convoy don reach Kobane for north Syria to hellep save lives for wia Syrian army and the Kurdish-led Syrian Democratic Forces (SDF) bin fight as ceasefire tuk continues.
Di humanitarian pipo say, dem bring 24 trucks wey get fuel, bread, and ready-to-eat food for pipo wey dey suffer because of di unrest for north Syria.
U sabi say, Residents bin complain say dem never get water and light for days, as Syrian army surround di town.
Say dis move na agreement with Syrian gornment, and dat finally, resident don dey breath fresh air for North Syria.