obodo oyinbo

Winter Storm Kill 11 People Across US

todayJanuary 26, 2026 6

Background
share close

By: Esther Ayoola

Say, one strong storm sweep across di United States kpai at least 11 people on Monday, as authorities warn residents make dem stay off road because of dangerous weather.

Di storm wey dem dey call dump snow,  do wetin nor good and na so  freezing rain from Texas reach New England, spoil light and flight cancel across many states.

New York City Mayor, Zohran Mamdani, tuk to reporters say five people kpai over di weekend, warn say extreme cold sti dey come.

For Texas, local authorities confirm three deaths, including one 16-year-old girl wey die during sledding accident.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app