obodo oyinbo

Iran Ready To Strike US If Gbege Happen

todayJanuary 29, 2026 9

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Iran foreign minister, Seyed Abbas Araghchi don yarn say Iranian army dey ready to immediately and powerfully strike back if US try attack dem.

Di warning land just hours afta US Presido Donald Trump yarn again say dem fit carry military action come.

Di USS Abraham Lincoln, one nuclear-powered aircraft carrier, na one of di many military tins wey US don send go Arabian Sea these past few days.

European Union foreign ministers dey plan put new sanctions on Iran, wey fit include travel ban and freeze of money and property for Iranian officials wey dem talk say dem get hand for kpai kpai of thousands of antigovernment protesters since end of December last year.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app