By: Esther Ayoola
Nigerian Association of Resident Doctors (NARD) don give wi Federal Gornment four weeks to finish all outstanding tuks wey concern salary, allowance and welfare.
Dem talk dis one afta dem finish dia National Executive Council meeting and Scientific Conference wey hold for Jos, Plateau State from January 25 to 29, 2026.
Inside statement jointly signed by NARD President, Mohammad Suleiman; Secretary-General, Shuaibu Ibrahim; and Publicity and Social Secretary, Abdulmajid Ibrahim, NARD thank President Bola
Tinubu, VP Kashim Shettima, Plateau State Governor Caleb Mutfwang and other people wey dey involved for di matter.
Dem also extend di suspension of dia Total Indefinite Comprehensive Strike (TICS) for another four weeks, say gornment don dey make some progress.