By: Esther Ayoola
South Africa don declare Israel top diplomat for di country, Ariel Seidman, persona non grata and give am 72 hours to comot.
Di foreign ministry talk say na because e don break plenty diplomatic rules and even dey attack President Cyril Ramaphosa for Israeli official social media.
U sabi say, Tension don dey between South Africa and Israel since South Africa carry case go United Nations last year, dey accuse Israel of committing genocide for Gaza.
Gornment tuk say dis move na to protect South Africa sovereignty from any kind disrespect.