By: Esther Ayoola
Wi oga Presido, Bola Tinubu don spoil ground, say, all govos wey dey serve under di All progressives Congress na bi di oga of di party for dia states, not ministers, not Senators, not by who tey pass for di party.
Vice Presido Kashim Shettima, ni be oga presido mouth piece as im go represent am for Jalingo, take welcome Governor Agbu Kefas enter di APC for Taraba.
Tinubu say since Kefas don comot from Pipos Democratic Parti enter APC, e don automatically become APC leader for Taraba State.