Nigerian Politics

30 Results / Page 1 of 4

Background

OBODO NAIJA

Ironsi Family Burst Out, Tell FG Say Dem Still Owe Dem Apology And Compensation

By: Esther Daniel Wahala don reopen as family of Nigeria first military Head of State, General Aguiyi Ironsi, don face Federal Gornment, demand apology and compensation over di killing of dia son. Di family head, Imo Aguiyi-Ironsi, yarn on Thursday for sidun tuk say Ironsi na correct leader wey get vision for Nigeria, but dem cut him journey short after just six months for office. Imo talk say Ironsi no […]

todayJuly 31, 2026 10

OBODO NAIJA

Peter Obi Na Trader, Him No Fit Be Presido

By: Esther Daniel Edo North Senator Adams Oshiomhole done blast Peter Obi on News on Monday, say im no fit ever lead Nigeria. Oshiomhole call Obi ordinary trader who only dey pursue quick profit instead of long-term country project. Di lawmaker accuse am say im business na to export local jobs go outside while importing unemployment enter Nigeria. E insist say di country need real manufacturer to rule am, no […]

todayJuly 28, 2026 11

National

Oluremi Tinubu Promise To Wear Akwete Cloth If Tinubu Win Again

By: Esther Daniel Wife of di Presido, Senator Oluremi Tinubu, don promise say if baba Presido Bola Tinubu win second term for 2027 election, she go dey wear Akwete buba and wrapper. Iya ikulukuli tok dis one on Tuesday during her first visit to Akwete Weaving Cooperative Village for Ukwa East Local Government Area of Abia State, wia she announce ₦2 billion support to help revive di local textile industry. […]

todayJuly 22, 2026 12

Entertainment

Falz clear air say e never support any politician 

By : Jolayemi Olajide Nigerian rapper Falz don clear di air on Tuesday say e never openly support Peter Obi or any politician, as e yarn for siddun tuk. Falz say people get am wrong because all along na to encourage Nigerians, especially youths, make dem come out vote naim e dey do. Di singer explain say e believe for free and fair elections and no wan tie himself to […]

todayJuly 22, 2026 10

OBODO NAIJA

PDP Draw Line, Say Wike No Be APC Property

By: Emmanuel Ariyo-David PDP don clear air say FCT Minister, Nyesom Wike, still be their correct man and dem no get any plan to allow am waka go join APC permanently, even though e dey work for Tinubu government. Party tuk, tuk, Jungudo Mohammed, tuk dis one for statement on Wednesday, say Wike na one of dia biggest political tools and no amount of sweet tuk go make dem give […]

todayJune 24, 2026 12

National

How 13 Reps Members Switch Party For House As Dem Resume Work

By: Esther Ayoola As House of Representatives resume from four-week break on Tuesday, na 13 lawmakers announce say dem don change political parties. Speaker Abbas Tajudeen read di defection notices during plenary, with lawmakers from Nasarawa, Cross River, Edo, Katsina, Oyo, Delta and Bauchi states joining different parties. Most of di lawmakers wey defect say internal crisis, leadership quarrel and factional divisions for dia former parties naim be di reason […]

todayJune 3, 2026 14 2

National

Bala Mohammed Reject VP Rumour, Say im do president race with Jonathan

By: Esther Ayoola Bauchi State Govo, Bala Mohammed don clear air say e no get anything to do with aproko wey dey fly. dat im and former Presido, Goodluck Jonathan naim wan package PDP, 2027 presidential ticket. Di govo react afta social media gist begin spread say Jonathan naim be presidential candidate of one faction of PDP wey Kabiru Turaki dey do oga, madam for. And dis one hapun for […]

todayJune 1, 2026 12

OBODO NAIJA

APC Boast Say Dem Go Pull Over 10 Million Votes Again For Tinubu

By: Esther Ayoola Oya, look wetin dey sup for politics: Di National Chairmo of APC, Nentawe Yilwatda, don rake full newspaper say im party go collobi pass 10 million votes for di 2027 presidential election. Yilwatda yarn dis one for TV sit down tuk on Monday afta President Bola Tinubu win di party presidential primary with 10.9 million votes. Im explain say, di reason why im dey get dis kind […]

todayMay 26, 2026 17

OBODO NAIJA

President Tinubu wipe Osifo, collobi APC Ticket for Second Term Race

By : Jolayemi Olajide Oya hear the big gist for Abuja, as Baba Presido, Bola Tinubu don grab di APC ticket again, to run for second term inside the next election. Tinubu win dis primary election with big score wey dey throw backy, dey look opponent dey laugh, say dem nor reach. Di senior man presido collobi  10.9 million votes to flog di only challenger, Stanley Osifo, wey only get […]

todayMay 25, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds