By: Esther Ayoola
Wi oga Presido, Bola Tinubu don go do meeting with Kwara State Govo, AbdulRahman AbdulRazaq, for State House Abuja on Thursday, say make im con explain wetin hapun for Worro community inside Kaiama Local Government Area.
U sabi say, just days ago news report say jaguda boys enter woro community kpai over 160 people, wey gornment link to suspected jihadist fighters.
Afta, Govo Abdulrazaq explain to oga presido, e explain to tori pipo for outside gate say gorment don setup deadly squad called Operation Savannah Shield , and dat, dem go hellep protect Kaiama and bring peace back to di area.