By: Esther Ayoola
UN human rights chief Volker Türk don beg di world make dem stop di killing and war crimes wey dey happen for Sudan.
Di war between di national army and di Rapid Support Forces (RSF) don dey go for almost three years and no sign say e go stop anytime soon.
Survivors tuk say RSF don kpai plenty pipo for El Fasher, some because of dia non-Arab ethnicity like di Zaghawa people.
Di UN want make arms embargo wey dey Darfur extend go whole Sudan to try stop di palava.