By: Esther Ayoola
Beijing don wire “serious warning” to countries wey dey criticize 20-year jail wey dem give Hong Kong pro-democracy businessman Jimmy Lai.
Countries like America, Britain, and Australia say di sentence no fair.
EU tuk say dem no happy with di punishment and want make China free Lai, Asap.
China foreign ministry tuk say some countries dey use di court case to whine pipo of di world to do bad against Hong Kong, and dat, dem nor go accept anyhow doings.