By: Esther Ayoola
Say United States don send about 200 soldiers to come Nigeria to train Naija army how to fight Islamist militants.
According to report from di Wall Street Journal on Tuesday, One American military oga tell di newspaper say the deployment hapun few weeks afta President Donald Trump accuse Naija gornment say dem no dey protect Christians well from terrorist attacks.
Di report tuk say di US soldiers go help strengthen Nigeria counterterrorism power through training and operational support.
Di new troops go join small number of US military advisers wey already dey Nigeria, wey dey help local forces with intelligence to find targets for military strikes, US and Nigerian officials tuk.