By: Rilwan Agbomeji
CAF don send team of technical people go check stadiums and oda facilities for di three countries wey go host 2027 Africa Cup of Nations, Tanzania, Uganda, and Kenya.
Dem win di bid wey dem dey call PAMOJA 2027, pass di joint bid wey Nigeria and Benin Republic put.
Untop yarnings with tori pipo, CAF Presido, Patrice Motsepe say AFCON go come every four years afta 2028, and 2027 go be di last time e go happen every two years.
Di technical team go dey check facilities until February 17, and Motsepe go join di waka come Tanzania on Friday.