By: Esther Ayoola
North Korea leader Kim Jong Un, like dis dey face beta gbasgbose say im dey plan to make im 13 year old girl pikin, Kim Ju Ae, di next leader of North Korea
According to Seaul spy agency, say di pikin just dey follow her papa up an down, attend big big events, like im first trip to Beijing for September.
South Korea National Intelligence Service say, like dis dem don dey touch light di mata, even before di mata reach public.
Dem sti say, dem go dey watch if she go enter North Korea big party wey dem go do dis month, in case of any kpakam, say dem go show beta workings.