By: Esther Ayoola
Arsenal coachie, Mikel Arteta tok say Bukayo Saka fit play for center mid role afta dem win Wigan 4-0.
Saka no suppose start, but he enter last minute because Riccardo Calafiori wunjor for warm-up.
Myles Lewis-Skelly come shift back from midfield go left-back, Saka dey center behind Gabriel Jesus, with Gabriel Martinelli and Noni Madueke for each side.
Say dis last-minute change  confuse Wigan, helping arsenal revenge dia 2014 FA Cup semi-final lose.